I
bet say those of us wey don dey around for some time know who
and wetin 007 dey synonymous with - 'James Bond' The
CIA ops! sorry MI5 British agent and we all know
James Bond's reputations- bullet no dey hit am not to talk of
dying in a film, if e remain small make dem kill am 'Mr
Scallamanger' go intervene or e go use one kind
teknology resue himself, so for people wey give IBB the membership
number 007, e be like say dem know say the man na the James
Bond of our time - The Untouchable.
For
IBB wey Naijirians don give so many nicknames before from Maradona
to the Evil Genius, e be like say this new one
'James Bond 007' go
be the top of the pack. PDP beware of the suave style of Agent
007 - the master planner and chief executionist becos if he
no be 'Dr No' he could be 'The Spy who love una' or
even 'The Goldfinger' with midas touch, whatever
na we sabi..