|
Kudos
to the electorates, the new democracy in Nigeria is now NO
WORK, NO RE-ELECTION.
We
witnessed a lot of "shocking" defeats in this concluded election,
mainly for the South West region which is believed to be the stronghold
of the Alliance for Democracy (AD), a predominantly Yoruba party.
Before the election, na AD dey control the six Yoruba states (Lagos,
Oyo, Ondo, Ogun, Ekiti and Osun states) but by the end na only
Lagos state dem fit retain. Wetin come happen for the other states
now o?
|
|
|
See
dem, Carry Go Governors, dem for don tell Baba Iyabo not
to field in any PDP gubernatorial candidates for the southwest
states well before the election.
Imagine
one of dem wey wan rule his state for the third or fourth time
as if to say na only him dey the state and na only two terms the
constitution allow.
Another one dey wey him pikins dey behave as if dem be royal
family, even the kind life and enjoyment wey dem live, Prince
William and Harry for London no live that kind life. We go see
wetin go happen now as their Papa don lose.
We
hope say other governors and the incoming ones go learn lessons
from these discarded "old cargos"
and do something better for dem people because the era of "lie
lie" to get people's vote don pass. Na wetin you sow you go reap
now. C'est fini! 
|