Gist & Gossip

AGBANI DAREGO’S “KEEP LONDON CLEAN” OUTFIT AT KANU’S BASH.

We think say “celebrities” know wetin dem suppose wear for big occasions i.e. colour combination and size? If so, we think say the current Miss World, our own Agbani Darego needs some lessons on outfit for occasions, or how person go explain the “oversize” dress wey the girl wear come KHF 1st Year Anniversary Dinner and Fundraising held in London.

The outfit is like the ones wey the late Queen Mother  dey wear when she dey young or the one wey we dey call “maxi” back in Africa.

 

Na so the cloth wey full ground dey draw after her, like old fashioned wedding gown. The girl nearly fall on many occasions as the long gown dey tackle her long legs like the way Okocha dey dribble, no wonder she no stand up much at the occasion and the few times she did other guests nearly tripped on her long flowing gown. After some time she got an “escort” to help her give people “C Caution” as she dey pass so that nobody go fall down courtesy of her outfit.

One thing wey we notice and wey the hotel management and staff go dey happy for, be say they will not have to sweep the floor after the occasion the following morning, as Agbani did a good job sweeping the floor with her “keep London clean” outfit.

Mademoiselle Darego, abi na borrow u borrow the dress because you got the invite late? as the dress no be your size at all, tell us and we go understand.

Watch out for the concluding part of this gist. You will be amazed at wetin “stardom” fit cause.

 


AGBANI DAREGO’S “KEEP LONDON CLEAN” OUTFIT AT KANU’S BASH
NIGERIAN HOME BASED PLAYERS IN LONDON
TEARFUL NEW QUEEN
CLINTON AND AFRICA
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.