Gist & Gossip

ANYIM TO LEAD SENATE TO NATIONS CUP.

Wonder them say will never end. My people I think una hear wetin our senate president and im members wan do again upon all the crisis for the country.

Imagine the senate president saying he wan lead him members go Mali go support our  Super Eagles Daddy goose for the competition.

Wetin dem think say dem dey do there self?

 

We tire for these people o, imagine they never quench the wahala for Senate house sef, dem wan go dey watch ball. Who these people think dem they self? Abi dem think say we no know wetin we dey do before we elect them?

Abeg make our people tell them say na to make law, dem they for, no be for supporters club. Make dem know, say we no dey carry "Ghana must go" bag for the place o!

So our dearest Lawmaker, please stay at home and make Nigeria better. Super Eagles Supporters Club still dey kampe and never tire.

ANYIM TO LEAD SENATE TO NATIONS CUP.
OYINBO WAN PLAY FOR NIGERIA.
MONKEY DEY WORK BABOON DEY CHOP.
CONTROVERSY TRAILS AGBANI DAREGO
MISS WORLD EMBARRASSED…. HOW KSA RESCUED HER
WHY STELLA DANCED AT MISS WORLD DINNER
PAY AS YOU ‘GROAN’ [GO]
ANTHRAX SCARE IN NAIJA SCHOOLS
   
  Archives...
 

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.