Gist & Gossip

KWAM 1 AND BALLOT BOXES?


Wonder dem say shall never end abi wetin una wan say about the alleged stealing of ballot boxes during the last gubernatorial election for Lagos state by Fuji musician King Wasiu Ayinde Marshal (KWAM1)?

Gisters crew hear rumour say the popular musician was caught with stuffed ballot boxes on the day of the election although he don deny the allegation and we believe am.

Well OLUAYE (meaning King of the world) of Fuji, make you no mind dem jare, na bad belle dey worry dem, especially when you just buy your moving house 'Lincoln Navigator' with registration numbered "Lagos 1". But after all said and done, haba Oluaye, na "Fuji Collection" we know you for, how come this "Ballot Box Collection" saga? Abi Fuji music no dey sell again.

If you too wan run for a post, you for don carry out a political campaign by releasing an album.
Abeg na "Fujician" we know you to be, no be politician, so make you leave politics for politicians and wait for them to come spray you our money wey dey don chop.
Alhaji, please dey watch am o, as we no wan anybody to tag you OLUAYE of BALLOT BOXES.

WANTED! TRUE NAIJA BEAUTIES WHERE HATH THOU?
AD GOVERNORS - THE MOMENT OF TRUTH
KWAM1 AND BALLOT BOXES?
OMISORE - FROM DETENTION TO THE SENATE
NEPA STRUCK AT MINISTER'S HILL ABUJA
COMICAL ALI - Comedian of the Year
 
Archives...

Copyright © 2000-2003, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.