Gist & Gossip

World superpowers to seek NEPA support

Some cities in the US, Canada and London in the UK recently experience wetin we dey experience permanently for Africa when their NEPA Look Alike take their light for some hours. To many Africans wey dey these cities we sure say such an occurrence no go bother them at least we don dey use to suc back home now, abi I lie?

But no be the same for our oyinbo brodas and sistas, na that day dem know say "khaki no be leather" as most people dey trapped in the subway in the US and the underground in London, even na outside many sleep for New York (that one no dey new, at least na outside we dey sleep back in the village to get fresh air wey no get pollution).

Yours truly happen to dey for town when the London episode happened, come see how people dey panic as if Armageddon don come. Well, we no blame dem there is a saying that "person wey don see the fight of god of thunder before, he no go follow dem abuse am".
We go advice Small Bush and Tony Lair sorry Blair make dem relax small for these dem "War on Terror" and go to Naija to meet Naija NEPA officials, make dem teach dem how dem dey rotate electricity supply for the citizens. There is no shame in getting lesson from one of the best "crisis management" guru in the world in terms of power supply, at least we good to the extent say we dey supply our neighboring kontries with uninterrupted power supply while we dey enjoy "uninterrupted power failure".

The boring saga of Item 8 - Fashion Show!
Solek Crew - "The intrigues, politics and bad belle"
Shan George in "yawa" at EMMA Awards
Aso Rock Villa, No. 1 illegal structure in Abuja
World superpowers to seek NEPA support
 
Archives...

Copyright © 2000-2003, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.