Gist & Gossip

Blunkett The Fast Track Man

My fellow people, Gisters Crew no go judge this time, but we go leave am for una to imagine.

Na our just retired respectable Home Office secretary David Blukett, that's for those who dey leave for Queens Land, may be equivalent of Maradona El Rufai for Naija or whatever, dey cause comotion for England O. If na deportation orders im dey give, or refusal of visa to applicants, we go say na the job wey Mr Tony B-Liar send am be that.

But to our surprise, the thing wey people wey dey see with dem two korokoro eyes no fit do, na im our David wey no see at all, dey do Falaaa.. Folooo...

The revelation still dey baffle us o, how person wey no fit see dey toast another man's wife to the extent im dey claim say na im father the children wey that one born. As this one dey go, another tory don come out again say our amiable David dey romance his secretary for office. We just dey wonder, how dem dey do the thing, e be like say na the guide dog wey dey guide him around during the day, still dey guide him for the thing at night.

Also dem say im dey use Fast Track to collect visa for im mistress nanny, although that one no new to us at all, na Long Leg or Man knows Man be that, we understand....hmm.

Mr Action Blunkett, we troaway salute O. We just hope say you don relinquish your disable badge if you get one, as your action don pass that level.

This is a Red Alert warning for Husbands, Lovers, Fiancees & Boyfriends wey dem madam wan apply for Stay/Paper to start fasting and praying and be more vigilant as Mr Blunkett dey on rampage Operation Fire for Fire O

Jesus - A Black Nigerian Man or What
Mr Blunkett on Rampage
Kofi's Fund Raising
Bling Bling Vs Penkelemesi
Naija @ WTM
OBJ with The Golden Egg
All Geneveive Award Night
   
  Archives...
 

Copyright © 2000-2004, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.