Naija
people go do anything for money even if the thing go take dem life.
As una know say if conflict or war dey anywhere na so different
gofment go dey arrange to evacuate dem citizens from the conflict
area either by directing them or by providing aircraft wey go take
dem to safety.
Na the same thing OBJ gofment do for our brodas
and sistas wey dey for Liberia when dem charter
a Boeing 747 and come give dem boarding passes to bring dem home.
Alas when the plane land for Lagos na foreigners full am. |
|
Na later confused gofment officials know say na "long
throat" make dem end up in Lagos with a plane full
of foreigners instead of Nigerians. The story be say dem sell
their boarding passes thereby jeopardising their safety
for money. Na we go dey complain say our gofment no take care of
dem citizens wey dey abroad, wetin we wan make OBJ do again o? |
Now these same greedy people wey still dey Liberia now want Baba
Iyabo make
he send anoda aircraft
to Monrovia so as to comot them from there. When the gofment refuse,
come see as dem storm the embassy and hold the innocent workers
hostage as if say na "Die Hard"
dem dey do.
The Nigerian gofment don agree to send anoda rescue plane now and
dem don warn dem say that will be the last one. So therefore, make
he who get ears listen well well o, make long throat no come kill
una for place wey no be una papa land. Shikena!!!
|