Gist & Gossip

THE GREAT OLD PALS REUNION IN LAGOS

So many water don pass under the bridge when yours truly no dey around o, politically, socio-culturally (umm!!! una no see say I bring big big grammar from my trip?).

The one wey we wan talk about now na the Liberian issue wey we call the "Three Musketeers" starring Charles Taylor, Baba Iyabo and the original bushman himself George Bush a.k.a. "Small Bush" ala Comical Ali.There is a saying that "if you live by the sword you die by the sword". Wetin Charles Taylor be before he become Liberian president? No be Rebel Leader? Why he come dey complain and dey beg international forces make dem come to his aid now. Abi he don forget how him and his rebel brothers torture and slaughtered thousands of their own people during the Liberian civil war?

Uncle Charlie, rebel moves no dey again?
You no suppose fear anything now, you wey fight with your rebels from the bushes of Ivory Coast into Monrovia in the 90s. How this small uprising go wan make you shit for body? We even hear say dem don indict you for war crime and your warrant of arrest has been issued. Well that na understatement, if there is any other crime wey dem fit indict you with make dem carry go.


Na now you come know say Nigeria na your big brother? Well as a good brother's keeper we no mind to give "Charlie Boy" "save haven" in Naija according to the one and only Baba Iyabo. At least he no go feel lonely as one of his "good friends and brother" Yormie Johnson too dey enjoy Naija hospitality at the moment after Charlie wan yamutu am.

Na so life be sha, at least na the Nigerian- led ECOMOG forces "(s)elected" Charles Taylor as the Liberian president in 1997 to stop the civil war. Na dem wan carry am comot again. Abeg Charlie no worry na "home" you dey go.

Intelligence report wey dey reach us sef say the two warlords go be neighbours in Lagos as soon as Charlie is ready to take cover in Naija. Trust Gisters, we don make arrangement to dey follow their day to day activities so that we go fit show am on the TV programme Neighbours from Hell.

BEWARE!!! SLEEPING GIANT OF AFRICA WAN WAKE UP
THE GREAT OLD PALS REUNION IN LAGOS
MOBILE PHONE HANDS FREE KITS - THE NIGERIAN STYLEE
BOARDING PASS FOR SALE - NAIJA AND LONG THROAT
COUP DE'TAT IN ANAMBRA STATE
WANTED! TRUE NAIJA BEAUTIES WHERE HATH THOU?
AD GOVERNORS - THE MOMENT OF TRUTH
KWAM1 AND BALLOT BOXES?
OMISORE - FROM DETENTION TO THE SENATE
NEPA STRUCK AT MINISTER'S HILL ABUJA
COMICAL ALI - Comedian of the Year
 
Archives...

Copyright © 2000-2003, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.