gist & gossip

Clash of the Titans spoils Naija Corner @ the Carnival

 

Dem say "when two elephants fight, na the grass go suffer". So when two heavyweights in dem respective field get kwanta with each other all we can say na to beg both parties to give peace a chance and cease fire like we dey beg for cease fire in Dafur.


We hear say na because of this misunderstanding, Naija people in the UK were denied of our famous Nigerian Street at this year Notting Hill carnival, with both parties pointing accusing finger to one another. Haba, even the organisers of the whole carnival no get this kind problem with each other how come we wey be say na only satnd we suppose organise for the canival.

As una know say we no dey take side for Gisters, all want na for peace to reign in our Naija community here in London, and when two most prominent people in our community her dey fight each other, something must be done.

Dem say " elders no dey dey for market make newborn baby's head twist", so we beg all the elders in our community here not to to take siddon look approach to this matter or take side but make dem try and call both parties to settle this matter.

And to the two "elephants" fighting. Make una remember say una be role models in our community here o and a lot of youngsters dey look up to una o. Chikena!!!

 

Clashes of The Titans spoils Naija Corner @ The Carnival
Golden Eaglets - We are The Champions!!!
   
  Archives...