Gist & Gossip

COPU DE'TAT IN ANAMBRA STATE

This na real case of "Osondi Owendi" - while some people dey happy some dey cry.
If una think say there is anything in this world wey no fit happen make una just take a trip to Nigeria where anything fit happen at anytime and life go continue.
Abi how we go explain wetin happen recently for Anambra State when some people "overthrow" the Executive Governor in a coup de'tat because the man no
"settle" them.


This na serious matter o, how people go dey "overthrow" state governor when the federal gofment dey there. See me see trouble o, na civilians like you and I dey do this kind job.

Na wa o, the gist be say some "disgruntled elements" wey wan use the governor to embezzle money decided to "Governornap" the governor when he refused to "play ball". The master- minder of the whole show wey dem call the "political godfather" of the governor talk say the overthrown governor must pay him Three billion naira wey he claim he "invested" in the political campaign before the election. As the governor no allow ''godfather'' choose the state commissioners and other gofment officials, that na why the overthrow episode happen.


We hear say dem even write the governo's letter of resignation and forge him "autograph" after dem don "governonapped" am and the man still no wan "cooperate"

Haba! even if person "invest" in a "business" like you claim you did, you suppose give the business some time to stabilise now. How you wan make the "business" grow if you come collect Three billion naira wey una suppose to dey use to "trade"?

We know say Anambra State na your "business venture" but e be like say the "General Manager" (Gov. Ngige) wey you "appoint" no go listen to the "Chairman Chief Executive".

Nna abeg make una take am softly softly o. Make una no dey disgrace Naija for public .

BEWARE!!! SLEEPING GIANT OF AFRICA WAN WAKE UP
THE GREAT OLD PALS REUNION IN LAGOS
MOBILE PHONE HANDS FREE KITS - THE NIGERIAN STYLEE
BOARDING PASS FOR SALE - NAIJA AND LONG THROAT
COUP DE'TAT IN ANAMBRA STATE
WANTED! TRUE NAIJA BEAUTIES WHERE HATH THOU?
AD GOVERNORS - THE MOMENT OF TRUTH
KWAM1 AND BALLOT BOXES?
OMISORE - FROM DETENTION TO THE SENATE
NEPA STRUCK AT MINISTER'S HILL ABUJA
COMICAL ALI - Comedian of the Year
 
Archives...

Copyright © 2000-2003, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.