Gist & Gossip

CUNNY MAN DIE CUNNY MAN BURRY AM

Nigerians are known to be very talented in all aspect of life. When other nationals are thinking in a way about something, a fellow Nigerian is already thinking about the same thing the same way but with over 100 different alternative ways.
A typical Naija man can be likened to an in-form striker that is ready to convert half chance into goal at any given opportunity.

 

Una go say my grammar dey too much abi? Abeg make una no vex na the way wey my fellow country men dey use dem brain dey make me trip.
I think na all of us still remember that sad day in September last year, I mean September 11 wey the Americans dey call 9/11 now ( dem no know say na lorry wey dey ply Lagos to Onitsha dem dey call 911).
Trust Nigerians now, we don devise another means to make money out of anything. One Naija man wey claim say he lost loved ones in the attack don land for police "wahala" for God's own country.
"Alarm blow" when our brother go file a claim with the Federal Emergency Management Agency wey dey provide relief for those wey suffer terrible tragedy of the WTC event, asking for relief money for his wife's death.
Investigation reveal say the man no even get girlfriend talk less of wife sef and upon all na illegal immigrant he even be.
Well make him family dey expect am for Lagos soon if the American authority no say make he get "stopover" for "Alcatraz" first.

ABIA STATE GOVERNOR FINISH FIRST DEGREE
NIGERIA AIRWAYS OR "AIRWASTE"?
AWOOF DEY RUN BELLE
THE NEW IMPROVED KANU "JOGO BONITO"
CUNNY MAN DIE CUNNY MAN BURRY AM
Gisters chill out with KSA
"Intellectual intellects" = Gari for common man?
"Commonwetin"?
"Nigeria Airwaste"
   
  Archives...

Copyright © 2000-2002, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.