gist & gossip

We are the Champion!!!

Nigerians home and abroad were rejoicing recently when the Under-17 national team, "The World Golden Eaglet" won the FIFA U-17 World Cup for the third time in South Korea.

Like the saying goes that "the pikin wey do good na him papa own am and the one wey do bad belong to the mama" na so the Eaglet's story be.
After the team don win the World Cup, na everybody dey lay claim say dem trust say the team go win and believe say the coach na "world class coach".

CHEI NAIJA PEOPLE!!! Na the same coach wey una don call all sorts of names to the extent of branding him "illegal" coach na him everybody dey sing him praises now for winning the cup.

Na only God know why we no dey wan give people chance and when they succeed we go wan become part of the success,

It is understandable and deserved when everyone wan reward the team and be recognised with dem success but it would be better next time we we support our team from the beginning not when dem don win against all odds.

Abeg now wey everybody dey promise the boys everything, we hope say no be to score some cheap political poits o and make una make sure that all the promises are fulfilled o because some of the 1980 African Cup of Nations Green Eagles winning team still dey wait for the house wey the then gofment promise them for Festac Town.

Well done boys and keep it up. UP EAGLET, UP NIGERIA!!!

Clashes of The Titans spoils Naija Corner @ The Carnival
Golden Eaglets - We are The Champions!!!
   
  Archives...