|
Please
anybody in da house wey sabi Dayo Adeneye aka D1, the one and
the only of Kennis Music for naija?? cos gisters dey look for
am o. We at gisters don dey get request from some toothpaste companies
for D1 for TV advert, as im teeth white pass snow and we are ready
to be his agent here as we believe him go make better money even
pass David Beckham, if he go for this. Can't you see as he flash
his full toothed smile in the picture he took at the Last Naija
Independence Jam in london recently.
|
|
|
So
bros D1, make you consider our offer as we will like you so much,
and it will be nice to be seeing your face everywhere on billboards
here London like our own Agbani. Please continue to use 'pako'
(chewing stick) o as we believe na im be the secret, even sef
you fit give the oyinbo the receipe, cos their own fluoride no
dey really make the teeth white as you can see from Mr Tony Blair.

Abeg
Bros we hope say you no dey chop Kolanut (goro), make you no come
spoil business for us o ...
|