But
that one no be the gist, the real gist be say Uncle Sege and
his cohorts decided to potray Naija in good light by building
a 'designer village' just outside Abuja to showcase
typical Naija village life for 'Iya Charlie' to
see how well and nice people live in Naija rural villages. 'In
our dreams'.
We hear say the village built within two weeks has electricity,
portable water, good health care, large wide screen TV in the
village centre to monitor events at the summit, naah this
is unreal. In fact we hear say dem wan make the village
look like Matrix, but dem no understand the big grammar the
Matrix producer dey talk, and also na rent dem rent the people
wey act as villagers.
Why
we dey do this kind thing, are we ashame of how we be, why 'Farmer
Segun' no fit carry the Queen go original Naija rural
villages so that she go know say khaki no be leather.
Uncle
Sege, so wetin go hapen to the village now, please make you
allow people wey no fit afford expensive Abuja move in there,
before your boys start borrowing the TVs, equipments, generator
go their house o. Remember our former sport minister wey borrow
Stadium generator go do im mama burial o...