Na
only last week another guy replace im electric consumer unit.
We hear say the guy no fit sleep for night. As he switch on
his TV, na im washing machine dey start to work! If he wan cook
na fire alarm go dey hala, as if to say ghost dey the house…
Trust Naija, our survival instinct strong pass Marine Commando
wey go fight for Iraq. We no kuku blame our people because
no be everibodi fit play football for Chelsea at this stage
as our bones don develop finish so we no fit run too fast
make we no go get heart attack!....Na heaven be the next stop!
The concern now be say as our people dey change profession like
say dem dey download music from internet we hope say dem no
go collect contract from Westminster and the whole building
go come scatter o!
Well, at least man must whack but make una careful o make
survival no come land man pikin for Belmarsh Prison o.
Have
you had any experience with these "Professionals" recently?
Either good or bad, let us know...
IT
Qualified DIY (Experts)