|
Look at Brother Ike, una
no think say the keeper needs to do eye test? Or how
he wan convince us that he no get sight problem, when you look at
the first goal and also the second goal? Wetin he lost for ground
wey he dey look for, when the ball don enter net? May be he still
dey see double after his clash with Okoronkwo against
Ghana. We only hope say he will not turn out to be another Peter
Rufai '98 for World Cup 2002.
Sorry Pastor Taribo, that boy Diouf El Hadji no even respect your
wealth of experience as he just dey play with you up and down,
well God dey.
I hope say Okocha, Kanu and Finidi don learn now say youthfulness
too get im own part to play for football.
Big shame on una, na 10 men
Senegal una no fit beat, if they come complete nko? Only God knows
wetin go happen, may be dey fit spell 'Nigeria' (8-1) for
the Score Board.
Anyway Our Dearest Fellow
country men, don't worry World Cup still dey, make we keep fingers
across and pray to God.
|