Gist & Gossip

SUPER EAGLES IN FASHION SHOW.

Una go say we don come again o. Abeg, na wetin we send our Daddy Eagles go do for Mali? Is it to play ball or to go do fashion parade?
I think say all of una notice one thing, wey we too noticed for these players: Their Hairstyle.

Old men wey dey pose, I tire for these people o.

No wonder the Algerians nearly spoil show for us, because the time wey our players suppose take train and blend well, na for hairdresser saloon dem dey go sit.
Let us now tell u the secret about these their hairstyles, una know say most of them don old and even sef some don dey grow grey (we sabi them), so in order to cover up, now they now go "funky" with their hairstyles.
Those that no fit do the kind wey Oliseh, Kan-ooooh [according to Arsenal fans], funky mallam [Babangida], Nkechi's husband and the Pastor Taribo dey do, now result to skin cut to hide the grey hair abi we lie, our Ipswich striker for example


Make people tell them O, if this Cup no reach Abuja at the end of this
competition  na wahala o.

SUPER EAGLES IN FASHION SHOW.
KUFFOUR SENT HOME
ZAMBIAN PLAYERS AND COACH DOWN WITH FLU.
Mali Gist in Brief
ANYIM TO LEAD SENATE TO NATIONS CUP.
OYINBO WAN PLAY FOR NIGERIA.
MONKEY DEY WORK BABOON DEY CHOP.
CONTROVERSY TRAILS AGBANI DAREGO
MISS WORLD EMBARRASSED…. HOW KSA RESCUED HER
WHY STELLA DANCED AT MISS WORLD DINNER
PAY AS YOU ‘GROAN’ [GO]
ANTHRAX SCARE IN NAIJA SCHOOLS
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.