|
Imaging
Eedris (Idrisu) Abdulkareem (Funky Me Suya) wey dey
struggle to appear for even common Channel O dey
do power struggle for reserved seat meant for 50 Cent
inside the chartered plane to Port Harcourt, before eye
open and close, he don start Nigeria own version
of WWE wrestling.
We
no blame am, he think say na inside Molue for
Costain e dey, where they go throaway blows to get the
seat.
But
at the same time, when we hear Idris version, im come talk
say fity dey do yanga and no even respect the Naija
Artists, so thats why he come show am say Khaki no be
leather.
Mr
Fity, if the allegation na true, you too don see say
Naija people no be one of those wey dey worship americans.
thats 'EKO for Show' for you
Abeg
make someone helep us ask Karimu if he still get
ambition to go Yankee go collect Grammy Award, becos
Fity and his hommies will welcome him with original
Gbula which his local bullet proof (ayeta)
no go fit stop O.
|