Gist & Gossip

Nzobu! Zobu! Enyimba! Enyi!

We cannot call the final of CAF Champions League wey take place recently between Enyimba of Aba, Nigeria and Ismaili of Egypt a football match instead na “footbrawl” or “royal rumble” fit the game. And upon all the body slams, kick in the groin, heavy blows, elbows, head butts and play-acting, the two gladiators still complete the match with all there players intact despite the fact say out of eleven players on each na only about three of them fit complete the match with ‘full body’.

Anoda yawa na the crowd, even al-queda no dey accurate reach dem when dey start throwing the ‘air to surface’ missiles so tay even FIFA President Blatter wey we consider as ‘African Friend’ take cover from the ‘bottlestic missiles’.

Kudos to the ‘Nzobu , zobu’ boys also becos dem show say Naija too fit win Oscar Awards for play-acting becos even if small breeze blow pass dem na for ground you go see dem, abi na oyinbo food dem eat, wetin happen to akpu and garri? And immediately dem fall for ground like person wey no get bone na one ‘Sisi Mama Nurse’ una go see running unto the pitch with boundage, iodine, pure water and robb go attend to them.

Well congratulations to Enyimba and Nigerians at least we don win the cup for the first time in 34 years now, but warning to CAF make dem provide extra security for the cup o and they should make sure say dem mark am with a significant sign, so that when dem wan collect am no be ‘Aba Made’ dem go get back. Shikena!!! ...

Nzobu! Zobu! Enyimba! Enyi!
Chicken-Heart Saddam
DESIGNER VILLAGE FOR QUEEN'S VISIT
NIGERIA IS SAFE ONLY BY TAFA
D1 FOR TOOTHPASTE ADVERT
   
   
 
Archives...

Copyright © 2000-2003, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.