|
Some
French speaking African countries still dey depend on their
colonial master, ‘France’ before they do so many things. The
thing wey dey annoying past be say dem no get their own treasury
to print their own money. No wonder Mobutu carry all Congo money
go France and Belgium when dem no open eye.
The
gist be say our brothers and sisters from the French speaking West
African countries like Cameroon, Ivory Coast, Benin Republic,
Togo, Senegal etc. depend on France for the printing of their
currency, CFA. The currency dey in acute short supply now because
France dey busy with the printing of the new Euro.
Even
banks no get old CFA notes to pay out talk less of new notes wey
people dey use to spray musician at occasions. But as bank and the
populace dey suffer, black market operators just dey enjoy, who go
blame dem, na dem say make dem country no get their own treasury?
Evensef,
we dey hear rumour say West African Nations wan do single currency
too. Na wetin we go call am…
'WAFA'?
We hope our Ota president no go sign any documents wey go
allow the money to be printed in France or UK
|