Gist & Gossip

ROYAL RUMBLE IN SUPER FALCON'S CAMP

We think say na everybody know say our 'Mama Eagles' don win the women version of the African Cup of Nations for keeps in Warri for Naija recently (at least dem don do wetin the 'Papa Eagles' no fit do since all these years upon all the taxpayers money we dem dey collect)We for Gisters Sports send our 'Congratulobia' to the team and their official for making us proud (even if to say na only African teams una fit shakara). We wish una best of luck for the Women World Cup in China wey una don qualify for.

As una know say for Gisters our eye no dey see make our mouth no talk, wetin happen for the girl's camp during the competition na something wey we no fit 'carry for body' alone. Una go just promise us say una no go tell anybody say na we tell una o
Wetin happen be say after the semi-final victory of the girls over their South African counterpart, Bayana Bayana (The Girls The Girls). Which kind name be this sef? Belle sweet the team coach so tay he wan allow fan wey dey wait for the girls in their hotel to be part of the 'jolliment' but the NFA official wey dey their Mrs. Lizzy Onyewenwa no wan hear anything like that when the coach insisted say the fan must be allowed to celebrate with the girls na so madam land Oga Coach one dirty slap in front of everybody.
The coach wey don dey teach his players counter attack for training no allow the slap to cool down before he land his own 'toxic slap' for madam's face (when he no be bastard). The venom wey accompany the slap wey the coach land dey deadly pass Rashidi Yekini's shot in his hey days, infact na ambulance come carry madam comot for the scene and na for intensive care unit for hospital she wake up come dey ask say wetin happen?


When G-Sport spoke to madam she said when the slap land for her face she passed out immediately, she even talk say she see her great grand mother wey don 'yamutu' ages ago. Una go think say madam get natural tribal marks after the incident becos na clearly 'coachito's' hand show for her face. Well na God catch madam, as elders dey talk am say 'na from outside dem go teach person wey no get home training' (we no say madam no get home training o). If na like that madam dey slap daddy for house we think say she don learn her lessons now.

Meanwhile if anyone get any slap wey hot pass that one wey madam get before the end of the year, get in touch with Gisters with proof of slap (mark for ya face) and win another correct slap from 'coachito' becos na him go represent Naija for slapping event for the next Olympics.


 

NIGERIAN POLICE AND ARMED ROBBERS - 'WETIN DEY HAPPEN'
ROYAL RUMBLE IN SUPER FALCON'S CAMP
XMAS AWOOF LAND OC FOR YAWA
PASSENGERS DEMANDED $1.3M FROM 'NAIJA AIRWASTES'
FIRST BANK NIGERIA PLC- ...TRULY THE FIRST???
ABIA STATE GOVERNOR FINISH FIRST DEGREE
NIGERIA AIRWAYS OR "AIRWASTE"?
AWOOF DEY RUN BELLE
THE NEW IMPROVED KANU "JOGO BONITO"
CUNNY MAN DIE CUNNY MAN BURRY AM
Gisters chill out with KSA
"Intellectual intellects" = Gari for common man?
"Commonwetin"?
"Nigeria Airwaste"
 
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.