|
The
fire wey dey cause wahala na the issue of N10 (less
than 5 pence) as monthly hazard Allowance wey our gofment
dey pay our fire fighters (Panapana). Wetin dem wan do
with that. How person wey get three wives and eleven kids
go feed im family on that? Even one tin of garri, you no fit buy
with N10.
No wonder when dem call dem to come put out fire dem go arrive
3 hours late because dem always have to push dem truck before
e start or say make you go buy fuel to put for tank or buy water
from pure-water. In most cases, when dem finally arrive, dem
hose no go long reach where fire dey burn becos dem don cut am
sell for Alaba market. Also if dem call dem say somebody don
fall inside well, dem go arrive without ladder because the
oga don carry the ladder go home so madam go fit use the wood
to cook food for house.
|