Gist & Gossip

FIRST BANK NIGERIA PLC- ...TRULY THE FIRST???

E get as e be for our so-called old school banks, when the world don dey move into the 21st century, some our our banks still dey for 16th century.
The famous Firstbank PLC wey dey refuse international passport as identification. Their outdated staff say dem no accept am to clear cheque say dem prefer drivers license or work ID infact the money no even reach 50,000 naira.

So why we dey blame Abbey National, NatWest and co for not accepting our Green Passport if the green thing no even dey relevant for our own yard.
Abeg make our own people know say na our hands we dey take mould our country and na the same black hand we go take destroy am, at least charity begins at home.
Please make our old generation banks retire their old school staffs and move with the new trend and "tekinologi" and employ young, agile and IT literate graduates make those wey be so-so clerk/counter assistant - turned oga no drive their customers away.


NIGERIAN POLICE AND ARMED ROBBERS - 'WETIN DEY HAPPEN'
ROYAL RUMBLE IN SUPER FALCON'S CAMP
XMAS AWOOF LAND OC FOR YAWA
PASSENGERS DEMANDED $1.3M FROM 'NAIJA AIRWASTES'
FIRST BANK NIGERIA PLC- ...TRULY THE FIRST???
ABIA STATE GOVERNOR FINISH FIRST DEGREE
NIGERIA AIRWAYS OR "AIRWASTE"?
AWOOF DEY RUN BELLE
THE NEW IMPROVED KANU "JOGO BONITO"
CUNNY MAN DIE CUNNY MAN BURRY AM
Gisters chill out with KSA
"Intellectual intellects" = Gari for common man?
"Commonwetin"?
"Nigeria Airwaste"
   
  Archives...

Copyright © 2000-2002, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.