Gist & Gossip

ZAMBIAN PLAYERS AND COACH DOWN WITH FLU.

Flu in Africa!!

Una do hear that before? no be catarrh we dey get for Africa? At least to our own understanding na Oyinbo land FLU dey.

How come Zambian national team players come dey get flu. Agreed most of them dey play in Europe, but na Africa we dey now. If dem talk say dem get malaria or
diarrhoea, we go understand but FLU? E get as e be.

Abi una dey fear una next opponent?

So tay coach to catch flu, that one even dey understandable because he be white man.

Abeg make somebody tell those players say people back home in Lusaka no wan hear any story, as they must make appreciable impact in the competition before they go back home.
Flu? if na joke make they stop am o as we no dey get flu for Africa, if dem dey fear opponent they should tell their fans before it is too late.

SUPER EAGLES IN FASHION SHOW.
KUFFOUR SENT HOME
ZAMBIAN PLAYERS AND COACH DOWN WITH FLU.
Mali Gist in Brief
ANYIM TO LEAD SENATE TO NATIONS CUP.
OYINBO WAN PLAY FOR NIGERIA.
MONKEY DEY WORK BABOON DEY CHOP.
CONTROVERSY TRAILS AGBANI DAREGO
MISS WORLD EMBARRASSED…. HOW KSA RESCUED HER
WHY STELLA DANCED AT MISS WORLD DINNER
PAY AS YOU ‘GROAN’ [GO]
ANTHRAX SCARE IN NAIJA SCHOOLS
   
  Archives...
 

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.