|
And
make una dey see o, this our Presido na correct farmer he be before
and even now, we even hear say he don ban imported food items
in Aso Rock. Instead na fresh food items from Baba's Otta farm
dem dey eat for the Villa now.
Farmer
Segun, wetin happen to "Operation Feed the Nation", at least na
you tell Nigerians during your first reign as a military head
of state to go back to farm, which you too come lead by example.
Abi na "Operation Starve the Nation" you dey for now?
Abeg
make una do something o, make e no be say na vegetables we go
dey import soon.
At
least if people dey fight you for your political policies, we
think say it will be wise to re-introduce Operation Feed the Nation.
Abi e don become case of person wey don chop and belleful no dey
get time to fight. And remember say "an hungry man is an angry
man", 2003 dey come o.
|