|
Recently
in London, The Ghana ruling party NPP organised
a fund raising dinner for the then upcoming presidential election
in Ghana for re-election of President John Kuffor. The
events have dem High Commissioner and other Ashante dignitaries
in attendance. But to our surprise, the whole organisation of
the event is like when Ojota Community High School dey
do dem end of term party.
Make
una check out the pros and cons (mostly if not all, CONS)
The
event was held at the so called Ajegunle of London, 'Hackney
Town Hall', one of the poorest Borough in London, it’s just
like OBJ having fund raising dinner at AJ City in
Naija, wetin happen to Mayfair or Park Lane????.
Donation
time! Blessing Time!!... dem target fund na just £20,000
wetin happen to £100 million? How a whole president go depend
on just £20,000 from his party for UK. The largest donor of the
day were a group of 50 Kofis donating £1,000 i.e. £20-£20
per person and if una come see the way dem dey jubilate, u go
think say Holy Ghost Fire don come down.
Una
need to see the “big drum”5-litre Keg wey dem take put
water in front of the poor High Commissioner. We no know whether
the man get “magun” wey be say na water be the antidote
or maybe he don chop too much “kenke and beans” so he need
lots of water to push the thing down.
If to say na posh water dem go buy sef we go understand. Na the
kind water wey dem Mr Rajah dey sell for all these low
cost shops wey dey copy Makro dem go buy. Even the wines
wey dem take decorate table, nobody fit drink am as there were
no corkscrew in sight to open them (so that dem go fit return
them) na all these ASDA value wine dem be.
If
this happen in Ghana, we fit understand, but na the Queen’s land
the thing happen and this buttress the saying that “you can only
take person comot for bush, you cannot remove the bush in that
person”.
But
we must confess say the thing wey our Gold Coast brodas
and sistas lack for class and organisation dem babes possess
am times 10 for structure and figure, abi how una think say the
saying “ko s’arugbo ni Ghana” (no oldies for Ghana) take
come about.
Abeg
Check them out...
|