Gist & Gossip

BEWARE!!! SLEEPING GIANT OF AFRICA WAN WAKE UP

Long time no see, abeg make una no vex na "runs" carry yours truly round the world for the past month abeg make una forgive am.
I
f some people think say na only corruption, election rigging, rioting, strikes and other anti-social vices we sabi do for Naija, make dem think twice o becos OBJ no go take shit from any kontry either politically, socially and most importantly MILITARILLY.

When Baba Iyabo visit Liberia to "persuade" his younger brother Charles Taylor to run for cover before dem rebel catch up with am like dem catch up with Samuel Doe that time, he drop one bombshell wey go make any true Nigerian proud.

At the international news conference after his tête-à-tête with Charles Taylor, OBJ made it known clearly to the whole world wey dey watch live on CNN, even plus including America say he go stand by his decision to allow Charlie to stay in Naija away from people who indict and wan arrest am.

"Baba L'egba"
said with a tone of finality as he dey comot from the news conference "I will not subject myself or the people of my country to any harassment from anybody or any country over my decision". Shikena!!!
We hope say "Small Bush" dey listen o. Naija no be Iraq or Afghanistan wey una fit shakara at all at all. We get our own "freedom fighters" like OPC, Bakassi Boys, Agbekoyas and many more who dey in the league of dem Hamas for Lebanon, Taliban for Afghanistan and Feddayen fighters in Iraq
.


If anybody dare to "carry nose" dem go know say, "nose na plastic". The thing wey happen to Yankee troops for Somalia in October 1993 wey dem "Black Hawk" was shot down in Mogadishu go be child play. This time around na "Black Eagle" e go be.

We hope say OBJ know wetin he dey do, make he no go make empty shakara if he no fit withstand the pressure o becos nobody send am make he go dey show Nigeria's "six pack" for public o.

Finally, America watch out! Becos e be like say the "sleeping giant" of Africa don wake up and maybe e still dey dream, na only God knows.

BEWARE!!! SLEEPING GIANT OF AFRICA WAN WAKE UP
THE GREAT OLD PALS REUNION IN LAGOS
MOBILE PHONE HANDS FREE KITS - THE NIGERIAN STYLEE
BOARDING PASS FOR SALE - NAIJA AND LONG THROAT
COUP DE'TAT IN ANAMBRA STATE
WANTED! TRUE NAIJA BEAUTIES WHERE HATH THOU?
AD GOVERNORS - THE MOMENT OF TRUTH
KWAM1 AND BALLOT BOXES?
OMISORE - FROM DETENTION TO THE SENATE
NEPA STRUCK AT MINISTER'S HILL ABUJA
COMICAL ALI - Comedian of the Year
 
Archives...

Copyright © 2000-2003, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.