CHEI
NAIJA PEOPLE!!! Na the same coach wey una
don call all sorts of names to the extent of branding
him "illegal" coach na him everybody
dey sing him praises now for winning the cup.
Na
only God know why we no dey wan give people chance
and when they succeed we go wan become part of
the success,
It
is understandable and deserved when everyone wan
reward the team and be recognised with dem success
but it would be better next time we we support
our team from the beginning not when dem don win
against all odds.
Abeg
now wey everybody dey promise the boys everything,
we hope say no be to score some cheap political
poits o and make una make sure that all the promises
are fulfilled o because some of the 1980 African
Cup of Nations Green Eagles winning team still
dey wait for the house wey the then gofment promise
them for Festac Town.
Well
done boys and keep it up. UP EAGLET, UP NIGERIA!!!