Gist & Gossip

OBJ With The Golden Egg

When we dey young our granpas and grandmas dey always tell us tory about a farmer wey get geese wey dey lay golden eggs and how rich the farmer was at the time.
E be like say we don get the modern day version of that farmer in no other person that Farmer Segun himself our one and only Presido abi how ordinary farmer go dey make $250,000 per month profit from his Otta farm.

We beg to differ sir. Na all of us know anybody wey get business wey dey bring a turnover of $250,000 a month no need any other job again abi una no see those Baba Ijebu landlords wey get almost 20 "ufsheers" (upstairs) or 30 molue buses for Isale Eko, wetin dem dey do again? No be 12 midday dem dey wake up with 'pako' for dem mouth calling 'Rasakiiiiii'.

Now Baba Iyabo say he dey make such money but he no fit joke with his estacode whenever he travels.... If he don forget we no forget say na him dem vote the most travelled Presido about two years ago, when he no be Osama wey dey on Pilgrimage all across the middle east.

We guess say na Otta farm dey supply all the food wey dem dey eat for Aso Rock but the thing wey we no know be say who dey sign the invoices? The thing go even dey easy, as na only one signature dem need from both end. Baba go just open briefcase bring out Otta farm invoice, write the cost and sign am with left hand , then he go sign the Aso Rock approval with right hand, so that the handwriting no go look the same. Genius Baba!!.

Well e no go surprise us if 75% of the $250,000 wey Otta farm make comes from Asokoro Rock. Abi anybody hear say Farmer Segun dey do importer and exporter, may be na him dey supply the British and American troops garri, akpu, ewedu, efo for Iraq or better still, may be the farmer wey our old folks dey tell us about, na im uncle, brother, sister, nephew, niece cousin, so he inherited the golden egg laying geese. Well GOD dey.

Jesus - A Black Nigerian Man or What
Mr Blunkett on Rampage
Kofi's Fund Raising
Bling Bling Vs Penkelemesi
Naija @ WTM
OBJ with The Golden Egg
All Geneveive Award Night

 

 

Archives...

Copyright © 2000-2004, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.