Gist & Gossip

HALF-BAKED POLICE GRADUATES

Una go say wetin Nigerian Police do us for Gisters, abi? No be say we get any bad belle for them but all na to make our dear country safe to live in.
How intending police officers go "graduate" from police college and he no go know how to shoot gun? Make una tell us which kind security such policemen fit give our citizens?

The gist be say trainee police officers no dey undergo the basic "weapon and ammunition handling course" wey be one of dem compulsory course for the college again. No wonder dem just dey kill innocent citizens by claiming "accidental discharge".
Instead make our police officers learn how to handle weapons like "Rambo", e be like say na how to use "catapult", "bow and arrow" and "cutlass" dem dey teach them with different style of mounting "toll gates" and collecting "egunje".
Abeg make somebody tell the Nigerian police say if dem no get the facilities, make dem carry dem trainees go any military formation for proper training o. Abi wetin dem go do if dem "oga the owner" come with sophisticated "artillery"?

 

At Last World Cup for Us!
Half_Baked Police Graduates
Local Hunters
LAGOS NA WA!!! - GISTERS' EXPERIENCE
Black Pickin White Parents
Kanu+Cash=Van Bommel
 
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.