In
a kontry wey fuel scarcity na common thing who go enter helicopter
make fuel come finish on top 'magidun
river', also, wetin we go do with all the NEPA
wires wey crisscrossed the whole of Lagos. After some
time now na 'tokunbo' helicopters
and 'tokunbo helicopter spare parts' go full
Cotonou port, Tin Can Island and Ladipo spare parts market so
tey we go get Aba and Onitsha made spare parts for the helicopters
at 'affordable' price, na then we go dey see many
of them end up crash landing or colliding with a molue (God
forbid bad thing) and again very soon if dem implement the idea
successfully we go dey get 'go slow' for sky too
and we may need to introduce the 'Congestion Charge or
LASMA' so that dem go fit tow away any helicopter wey
take one way or dey cause obstruction.
Abeg make somebody tell these people before they start wasting
our money say even for developed kontries like the US and UK
dem no dey use helicopter for public transport o, na special
use like transporting the sick and the wounded from a remote
area to hospital or for the police to tail VIP criminals from
the air while dem colleagues dey pursue dem on the ground. Shikena!!!