Gist & Gossip

NIGERIAN HOME BASED PLAYERS IN LONDON

There has been agitations all over the Nigerian soccer circle that the home based players should make up the bulk of the Super Eagles’ team for the World Cup, abi no be una talk so?

G Crew were with the players when they came to London for the friendly game against Paraguay last month and with wetin we saw the home based lad still get work to do if they wan play for the Super Eagles.


See as the guy dey admire Cele

The first problem wey dem get be inferiority complex as some of them dey play with the likes of Kanu, Okocha and Babayaro for the first time, imagine being on the same field with a player you dey watch on TV back in 1998 World Cup, the poor boys were just watching Jay Jay magic in training, wetin dem go do if they now meet Beckham, Veron or Ljungberg for World Cup, no be autograph dem go dey ask for on the field of play so?

Also the cold that night no do our brothers from Nigeria any good as most of them just coil up on the reserve bench during the match praying for the final whistle so that dem go fit enter their bus and head for the hotel.

When G crew asked one of them the name of the hotel wey dem lodge the poor boy say na one tall hotel dem camp (Hilton). Abeg make una tell me how many tall buildings dey for London city? Maybe the poor boy no know say dem plenty.

 


AGBANI DAREGO’S “KEEP LONDON CLEAN” OUTFIT AT KANU’S BASH
NIGERIAN HOME BASED PLAYERS IN LONDON
TEARFUL NEW QUEEN
CLINTON AND AFRICA
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.