Gist
& Gossip
|
The boring saga of Item 8 - Fashion
Show!
|
The
trend wey most if not all Naija events in London dey follow
nowadays is becoming worrying if not annoying.
Na all of us wey don dey attend one social function or the other,
know say on the programme of events there is a special number
that is reserved for "Menu! Menu!!
Menu!!! Which be "item seven" but one other
item which is now common on the Naija events programme of events
is what we dubbed
"item
eight"
Fashion Show! Fashion Show!! Fashion Show!!!
|
|
Item
7

|
Item 8

|
For
some time now no Naija event we una go attend, wey dem no go do
Fashion show, be it Book Launching, Corporate Business Luncheon,
Dinner Parties and any event una fit think of so far na Naija
organized am.
The thing wey dey annoy yours truly most be say, most of these
so called Fashion Shows are always out of place or how una wan
explain a Fashion Show at a Christian Book Launch or a Business
Dinner.
Anoda thing wey we no understand be say why these fashion designers
dey display size 6-8, jeans and denim products for an event wey
the smallest "sisi mama" in lace and Damask wey dey
there na size 16, no wonder dem no dey get people buy their
clothes, at least if dem display lace
materials, shoe and bag, gold jewelleries and other
stuffs wey good for "owambe parties" dem go sell well well.
|
|
|
|
|
Our
special plea to all the designers in the house, please do something
that our Sisi Mama can fit into. SOS.
|
Copyright © 2000-2003,
Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.
|