Gist & Gossip

ABIA STATE GOVERNOR FINISH FIRST DEGREE

Na everybody's ambition to go university one day, especially now wey be say degree na degree no matter how long. No matter under which circumstances e take person to get am, wetin important be say make person get mouth to talk when "University Graduates" dey talk. Dr Orji Uzor Kalu (who give person wey no get first degree doctorate sef?) wey abandon education for "greener pasture" abroad years back even siddon for the final examination in the University's hall with other students after which he talk say "I decided to go back to school, because I was challenged by negative press reports. Some of the arm-chair journalist said I was expelled from the University of Maiduguri".

Good talk, but e be like say "De Guvnor" don forget an adage wey talk say, "make hay while the sun shines". Abi who go respect this certificate wey he say he get now when we all know how even "proper student" dey take style get certificate for our university nowadays. Abi which lecturer go dey bold enough to fail the person wey dey pay him salary? Dem never born that kind lecturer. We even hear say the Governor sat alone in the examination hall with security men just a few meters from him. Wetin we no come know be say maybe na to prevent "His Excellency" from doing "giraffe method" on other students or vice versa.

We also gather say the man don dey think about going back for Masters degree sef with the intention of contesting for the post of Student Union President. We hope say "Mama Uzor" don warn am against joining bad gangs in school.

Abeg make people tell this "Mr Humility" say no be all of us be "mumu" at all. If he wan score cheap political points, may he find other means, no be to make noise with first degree wey even sixteen year old dey get nowadays. Na Phd your mate dey do now no be that one wey you talk say you get. No wonder lecturers no strike for the school at all (who go balme them, abi una don get work for them for Oil Company?)

 

ABIA STATE GOVERNOR FINISH FIRST DEGREE
NIGERIA AIRWAYS OR "AIRWASTE"?
AWOOF DEY RUN BELLE
THE NEW IMPROVED KANU "JOGO BONITO"
CUNNY MAN DIE CUNNY MAN BURRY AM
Gisters chill out with KSA
"Intellectual intellects" = Gari for common man?
"Commonwetin"?
"Nigeria Airwaste"
 
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.