|
As
the late Aaliyah sing say, "age is nothing but a number", this
logic no work for our broda o as that thing (AGE) don catch up
with our broda. We don dey see the sign towards last season when
Arsene Wenger only bring on our "golden boy" when his mate don
secure the match with two minutes to go so that the potential
"Igwe" from Owerri go dey hold the ball to run down the clock.
At least he contribute him own quota to bringing the doubles to
Highbury last season. Even sef for World Cup, bros no help matter
at all as he just dey hold belle for field, na only God know if
na true dem talk say na bruises he get for ribs because we think
say na diahorrea our broda get after too much "ofiewere, ofiesale
and ugwu". No wonder uncle asked the coach make he remove am so
that he go fit go "pooh pooh"
We
no dey surprise say dem put Kanoooooh for transfer list
at the end of last season but the thing wey dey pain "fellow Nigerians"
now na the way wey Arsenal wan ridicule our brother by offering
Kanu plus money for another player from PSV and the PSV chairman
rejecting the offer saying wetin he wan do with a "whole" Kanu
wey be Olympic gold medallist when he get better players. Imagine
the insult upon injury! Abeg, "Papillo" make you no worry our
prayers dey with you say make any club no buy you at least you
go dey play your "normal two minutes" and still dey collect your
"pension and giro".
Bros
we no blame you o, Kanu Heart Foundation needs funding jare.
|