But
the thing wey we no understand na how person wey dem wan sell come
dey score goals "yanfu yanfu" like this?
Well we are happy to "informate" una say Kanu na real traditional
man wey no forget him root. Una know say after the World Cup Kanu
went to Naija for holiday and talk am for newspaper in Naija say
Arsenal are not planning to sell him when for here dem dey look
for buyer for am.
Where this guy get this kind confidence? Well according to "intelligence
report" reaching us, while Kanu was in Naija, na village
he go siddon where elders and "Igwes" "cook" am well
well with "Afro Insurance" no wonder the "jogo bonito"
don come back and the guy no fit stop scoring.
Another thing be say now for Highbury where Arsenal dey play, some
"Igbo" brothers don get stand wey dem call "Kanu Shrine".
Anytime Arsenal dey play and oyibo fans dey shout Kanooooooooh!!
na "Nzobu! Zobu!! Enyimba! Enyi!!" una go dey hear from
"Kanu Shrine".
Abeg Kanu make you please helep another brother in need at least
dem say blood thick pass water. No forget your paddy "Jay Jay"
wey dey wander about for Bolton Wanderers. Him too need "Afro
Insurance" even plus including Uncle Finidi for Ipswich.
At least na you say make dem come play for the Premiership.
We go dey glad if you fit introduce dem to the "Baba" wey
helep you do ya own, all na for national interest. More elbow
to your grease abi na the other way round?
And we pray say make the effect of that "Afro Insurance"
no wear off soon. Even if e do na to go back village for re-insurance.
|