Gist & Gossip

'Presidential Road' Keep Off!!!

It is believed say when you dey represent ya kontry, you suppose enjoy some 'fringe benefit' and 'respect' especially if you happen to be a Nigerian wey dey represent Naija in sports. Infact you go enter molue, okada and even eat for buka for free provided you no eat pass certain amount o.

But with the experience of the Naija cycling team at the just concluded All african Games in Abuja from the hands of the overzealous 'majamaja' (FRSC) officials wey arrest, detain and confiscate their bicycles (maybe they wan sell them to palmwine sellers) for several hours. No wonder some of our best athletes dey go represent other kontries.

Wetin be their offence? Dem dey ride their bicycle on the route wey dem reserve for OBJ wey no even dey Naija that time talkless of being in Abuja and trust my kontry people after dem release the cyclists their coach tell reporters say if dem no win anything at the games (upon all the millions wey we take build world class velodrome for them) na the 'overzealousness' of the FRSC men cause am. Make una no mind them, even if dem no arrest dem wetin dem fit win? Wetin happen to the discovery of grassroot talents in sports? We sure say if una go Lalupon, Auchi, Fiditi, Nekede, Jebba and many more there are raw talents there wey be say na only bicycle dem ever ride in their life.

Obalende Straiiigghhtt! in the air
My name is IBB, Ibrahim Babangida - Agent 007
OBJ to sack 'Babysitters'
'Presidential Road' Keep Off!!!
The boring saga of Item 8 - Fashion Show!
Solek Crew - "The intrigues, politics and bad belle"
Shan George in "yawa" at EMMA Awards
Aso Rock Villa, No. 1 illegal structure in Abuja
World superpowers to seek NEPA support
 
Archives...

Copyright © 2000-2003, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.