|
Well,
we no blame dem, na the OC (officer-in-charge) we blame, when
dem suppose to dey guard the prison entrance, na dream oga dey
dream for sleep courtesy of 'awoof' ogogoro, palmy "33", akpeteshi
with several plates of assorted pepper soup so tay dem "oga the
owner" come carry rifle and even shot one of the officers. May
be that one dey talk for sleep.
Infact
the OC no gree wake up even as daybreak despite the fact that
a warder try wake am up. Na after dem pour water for the OC head
he manage to hear wetin people dey talk.
We
dey beg Oga IG, please no be only check point need attention,
infact na every department of the force need surgical operation
because na this kind 'negligence of duty', 'I don't care attitude'
and 'gross indiscipline' make us lose our Minister of Justice.
|