|
The
king of juju music King Sunny Ade come London recently to jollyficate
with his fans and show dem say he still dey kampe.
We know say una don see the foto of the show wey KSA do on Gisters,
but a day after the concert G-Crew was invited to chill out with
the Cool Samba exponent at his Central London Hotel. Infact KSA
na one kind man wey age no catch up with at all just like his
music.
|

|
|
|
Throughout
the two hours wey we spend with this fantastic man there was never
a dull moment. We gist from his music to his personal life, piracy
in music industry and politics. The man show say he dey sound
on all the topics.
KSA talk say e go be 36 years in December since he start to play
music ( dem never born me sef) with 111 (one onety one)
albums to his credit, the first one being "Alanu l'Oluwa" and
the last, na "Cool Samba".
|
When
we talk about piracy, KSA say piracy dey for every aspect of our
life and we must join hands together to fight the scourge even plus
including Gisters because as the king said, "m'okan m'okan
l'oye n kan, oye t'o kan ara Iwo o n bo wa kan ara Ede"
meaning if we no fight piracy now the thing go soon reach our turn.
The man no lie at all as some media organisation don dey download
pictures from Gisters without our permission.
|
|
When
we asked the king the level wey he think he don take juju music
to, he tell us say na him fans fit know the level but as for him,
he never reach the level wey he wan put juju music. It was a very
enjoyable and fun-filled evening with lots of jokes from both
sides.
|