Gist & Gossip

LAGOS NA WA!!! - GISTERS' EXPERIENCE

My people we dey sorry say we bring una this update late, all na to bring you better services and also for the thing to reach every corner for una jollification.
As una know say Gisters na UK based, but with very wide audience from our obodo Nigeria, that's why we say make we carry the good news go Nigerians door mouth for Naija "gangan". So na Lagos we dey since o, dey create awareness and set up our office. Una know say Gisters no fit go somewhere make we no get gist for una.The Lagos trip wey we go dey full of many experiences.

We don plan say we go dey update una beloved site from Lagos, but for where? The first "yawa" wey we face na this common phrase for Lagos "Internet Cafes", "oga, the server is down". If you come get luck see one place wey the "server is fast" and you balance to work, na so the almighty NEPA PLC (Never Expect Power Always, Please Light Candle) go do their thing and the next thing wey you go hear na "we go put on the generator now". If you wait for the so-called generator to come on you go wait "tire", becos all na "delay tactics" so that you go fit vex comot without asking for your refund.

Another thing wey we face for Naija na the "Men In Black" and their legal or illegal "toll gates" but we get antidote to this particular issue becos our man, George Otumu for Naija don yarn us the style. One night dem stop us for over four times from VI to Ikeja. On stopping us, come see as dem dey yarn, "Stop! Stop!! Everybody come down and hands up" and the style dem take cock their guns, una go think say na US Marines dey confront Osama bin Laden for Afghanistan. We just come down, hands up in the air, and tell them who we are, in slang wey we pick from our "tutor", "OC, how now, na WE o, press". They come become friendly after checking our ID and even advise us not to travel at night because it is dangerous, hmm!! Na true dem talk o.

The other stress wey we face for Nigeria na the "Almighty Lagos Traffic" We dey baffled with the rate of traffic jam on Lagos roads, imagine we left Apapa for 6pm we no get to Iyana Ipaja until 11pm. But as we look am G Crew think say na better thing becos it show say many people can now afford to own a car in Nigeria, wetin remain na for the government to make the roads motorable.

But we must confess we really enjoy our stay in Lagos as there is no place like home and Gisters is taking this opportunity to thank everyone wey make our stay and awareness campaign a success in Nigeria. We promise to be back in full force soon.


LAGOS NA WA!!! - GISTERS' EXPERIENCE
Black Pickin White Parents
Kanu+Cash=Van Bommel
 
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.
ssssss