Gist & Gossip

LOCAL HUNTERS TO THE RESCUE.

Na wa o, we thank God say Nigerian government don dey lead by example now as one of the northern states governors practise wetin government don dey preach since say make we dey make use of our "local raw materials" by using "wetin he get to achieve wetin he want".

As una know say our police for Naija don spoil so tay we no even respect dem again, especially students for our universities wey dey always confront the "Men In Black" anytime "yawa gas" for dem campus.
Wetin happen be say after a confrontation with dem oga "wetin you carry", the student were asked to go for break and vacate dem hostel "asap" but they refused. Dem even kidnap the deputy governor (that one no get security?) and dey ready for war with the "oga OCs".
But the governor remember the days of the old "wild wild west" in the Nigerian politics with the "Agbekoyas" by getting local hunters make dem chase the students comot from the hostel.
Infact una go think say na "African remote control" dem use for the students as dem just pack dem loads and vacate the hostels. Abi na just the sight of the dare-devil local hunters wey wear "charms and amulets" with dem dane guns wey don kill wild animals tire for bush make them get change of mind. Any which way, we give "high five" to the governor for his "innovation" that shows that "what a policeman cannot do a local hunter can do better".

 

At Last World Cup for Us!
Half_Baked Police Graduates
Local Hunters
LAGOS NA WA!!! - GISTERS' EXPERIENCE
Black Pickin White Parents
Kanu+Cash=Van Bommel
 
Archives...

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.