|
But
the thing wey she no know be say, Daily Times wey dey sponsor
the Miss Nigeria contest no dey send im winners go for
the Miss World contest for some years now due to financial
reasons. So I no know why she come dey cry over spilled
milk now, or na who say make she no contest for the Silverbird
Contest, [how she
go contest when she no even fine].
My
sister just keep your misery to yourself, because we know how
you take style win that Miss Nigeria contest self, abi you wan
make we expose you?
Abeg
no spoil party for us o!! If you wan be part of this great moment
you are welcomed, we fit even help you get an autographed
spaghetti top from our own Agbani Darego.
|