Gist & Gossip

MISS WORLD EMBARRASSED…. HOW KSA RESCUED HER

World beat superstar, King Sunny Ade averted wetin nearly bring shame and embarrassment to our naija music stars during the reception organised for the current Miss World, Agbani Darego in Abuja recently.

During the dinner wey dem organised for the beautiful girl at the Nicon Noga hotel in Abuja, the president of the PMAN, King Sunny Ade lobbied Patrick Doyle wey be the MC for the event to introduce him to the Miss World. Chei! star pass star o, even the people wey we dey call stars here too fit dey lobby to meet a greater star. Well God dey!!!

Back to the gist my brothers and sister, as the MC dey introduce KSA to the Miss world, another Lagos-based musician, wey no even be Guilder not to talk of being a Star just burst into the scene.

Na KSA rescue the poor girl from this man hand as he just untie the man hand from Agbani's waist and begin drag him to im seat. People around were 'flabberwhelmed and overgasted' at the scene, but some conclude say the man dey over joy seeing a Nigerian as the Miss World.

Well, which kind over-joy be dat? Abi he wan take him over-joy spoil show for us? Or he think say the girl na like those ones wey dey dance Makossa for Cousin T in Adeniran Ogunsanya Surulere?

Abeg, my brother make you stop that nonsense o, Agbani no dey for that kind thing again o.

 

CONTROVERSY TRAILS AGBANI DAREGO
MISS WORLD EMBARRASSED…. HOW KSA RESCUED HER
WHY STELLA DANCED AT MISS WORLD DINNER
PAY AS YOU ‘GROAN’ [GO]
ANTHRAX SCARE IN NAIJA SCHOOLS
   
  Archives...
 

Copyright © 2000-2001, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.