Many
people no know why the first lady dey too happy. In fact over
happy at the dinner organised for the Miss World in Abuja
recently.
We
hear say some people don dey chop the 'pancake mama' money
for some time now becos dem say them go bring the then reigning
Miss World from India [una remember the film: Abacha
and the Indian prostitutes?] to promote her pet project the
'Child Care Trust' since she say she need a big personality
to promote the project.