As
una know say most of the mobile phones wey dem dey use for Naija
na from brothers, sisters, uncles,
aunties, cousins, nephews, nieces, friends and
so on, wey dey live for abroad. Na so yawa gas when the law
come out becos maybe "brother Emeka,
sister Ruka, or aunty Halimat just send the phone
alone without the accessories.
But trust my people when one road block anoda one go open. Na
so my brothers and sisters devise a very cheap and "modern
hands free kit" wey dey compatible with any phone.
Whether you dey use Sagem, Sendo, Mitsubishi, Daewoo
or any other type of handset and most importantly na one
size fits all. Also it can never be out of circulation
becos na "rubber band"
wey dem dey take hold money for CBN.
The only problem be say CBN, other banks and offices go soon
run out of these "essential commodities".
At least na hands-free FRSC (Federal Road Safety Corp)
say dem want. Dem no say your hands free kit must be the same
brand with your phone.
Person no suffer he say he wise, who be im teacher? Suffer head
no good o. Walahi! I no know say poverty fit make people dey
as inventive as this.