Gist & Gossip

NIGERIA AIRWAYS OR "AIRWASTE"?

E be like say this Nigeria Airways palaver don dey get as e be now. We don hear enough stories from privatization to old model aircrafts and now seizure of our plane for Dubai. Even we don hear tire from passengers dem, from poor service at the airport, to missing luggage, snakes in the overhead cabin, rudeness of the hostesses, poor food on the flight and so on and so forth.
 

We sure say una no know say one of our aircrafts wey the Belgian government seize long time ago for not passing MOT (we no know wetin concern dem about that, at least the "bird" still dey fly) don turn to bukataria where people dey chop eba and amala for Brussels now.
These kind thing no good at all when una think about the kind disgrace wey all these development dey give our dear country, a country wey fit boast of world-class pilots.
Abeg my brothers and sisters wetin we fit do to revive our National carrier, abi e no good when we dey go Nigeria make we go inside our own aircraft wey we know say Osama bin Laden no fit hijack and also where we fit chop better eba, amala and akpu instead of all these leaves. We want una opinion and experiences on Nigeria Airways or "Airwaste"… whaever.

Have your say

ABIA STATE GOVERNOR FINISH FIRST DEGREE
NIGERIA AIRWAYS OR "AIRWASTE"?
AWOOF DEY RUN BELLE
THE NEW IMPROVED KANU "JOGO BONITO"
CUNNY MAN DIE CUNNY MAN BURRY AM
Gisters chill out with KSA
"Intellectual intellects" = Gari for common man?
"Commonwetin"?
"Nigeria Airwaste"
   
  Archives...

Copyright © 2000-2002, Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.