|
If
una no forget, recently when Gisters go Nigeria, we come back
come give una our experience for Lagos. We dey happy to inform
una say our man don go back now and he still full ground for Naija.
Last time when Gisters wan go Naija na one of these foreign airline
our man take go, but this time around for the sake of patriotism,
we decide to hit Lagos with our own Nigeria Airways. We no know
say na mistake we make as the first thing wey surprise us na from
Heathrow Airport in London.
If una see the corner wey dem go put Naija counter, una go pity
passengers not to talk about the staff. Make una dey see o, for
Lagos na the best space for Murtala Airport British Airways dey
occupy.
Secondly, when una reach NIGERIA AIRWAYS COUNTER who suppose
attend to una? NIGERIANS OF COURSE! Na lie na so so Pakistanis,
Indians, Bangladeshis with their "nei papa, nei mama" accent
una go meet there. Initially we think say na Air India or Pakistan
counter we go by mistake but when we see Nigeria Airways logo
for the place surprise catch us.
When the Indians and dem brother dey control our airline, na luggage
my brothers dey carry. Na dem dey load the luggage inside the
plane and somebody dey talk say dem dey create job opportunity
for we Nigerians. Even the pilot na from India, well sha God dey.
To add salt upon injury, our man travelled on Saturday dem
no carry him luggage go meet am for Naija until the following
Friday after our man here don go cause wahala for Heathrow. Infact,
our man nearly help them carry the baggage into the plane before
dem carry am.
Abeg make our government do something about this disgraceful act.
At least we get people wey fit do the work wey all these foreigners
dey do. Abi una don hear where Nigerians dey work on Air India
or Pakistan as hostess not to talk of being pilot. Well he fit
be cleaner. We need to get our priorities right as a country and
protect and fend for our citizens.
|