Gist
& Gossip
|
OBJ to sack 'Babysitters'
|
| The
'Presido', Baba Iyabo and his bunch of 'chop
& quench' officials show recently say na true be say 'behaviour
na smoke, there is no way wey we fit cover am wey e no go come out'
when they embarked on one of their usual 'globetrotting'
trips to Japan all in the name of 'estacodes' other than for the
benefit of Naijirians, according to our source. |
|
| 'Farmer
Segun' claim say the so called 'government unofficials'
abandoned him in his hour of need just like Peter abandon Jesus
Christ then when dem leave am to do their own personal business
and when he asked dem where dem dey since, two of dem say dem go
look for one of them wey dey missing. Imagine, the 'missing
official' is Andy Uba, the elder brother of Anambra
State political godfather, Chris Uba wey lead the 'coup' to topple
Gov. Ngige recently. |
|
Dem
say 'birds of the same feather flock together',
no wonder somebody wey dey bear Uba dey follow OBJ travel abroad
to 'represent' Naija, when gofment suppose runaway
from the Ubas not to talk of travelling abroad at our expense.
And make una dey see o, na one kind 'home made' portfolio this
yeye man dey hold, he is a 'Special Assistant on Household
Matters'. Where dem get that kind office sef, wetin be
him job, na under which ministry he dey? Abi na him dey in charge
of all the purchase of foodstuffs and other household ammenities
in Aso Villa like garri, yam, 'iru' (locust beans), ogbonno,
ugwu, ewedu etc. If so wetin he dey do in Japan with OBJ?
Abi he wan go import 'sushi', 'tofu', tsukenomo, gohan etc
for the household from Japan or maybe he go invite 'investors'
to come and open 'Japanese Buka' for Naija?
|
Haba,
Baba Iyabo, no be you dey preach 'transparency'
for ya gofment? At least you suppose lead by example
and practise wetin you preach if you wan naija people to believe
all ya noise about transparency and again we beg make you take
style sofry sofry travel abroad and sort Naija
problem out especially petrol, we know say you dey try to break
the Pope's record of most widely travelled person but we beg
you you still fit accomplish ya mission even when you leave
office but Naija need attention first.
|
Copyright © 2000-2003,
Gisters.com Limited. All rights reserved.
No reproduction permitted in any form.
|