"I
hereby assures all and sundry that the entire country is safe
and that there is no state or section of the country that is
under any security threat and there is security everywhere:
All law abiding citizens are implored to go about their lawful
businesses without any fear of molestation, as the force is
cut out to protect the lives and properties of all citizens
at all times".
Who
dey fool who? wetin oga IG wan say about the armed robbers wey
dey terrorise innocent citizens or the Ijaw/Itshekiri fracas,
to the Warri youths wey dey terrorise and kidnap oil workers
and the kontry is still safe ehn? E be like say na anoda planet
oga IG dey. Even sef Little Bush know say no where is
safe, for him to sneak to Iraq.
Abeg
my people and Uncle Sege, dont listening to him o, we know say
na grace of God dey protect us for Naija, no be any yeye security
by the oga IG and his 'anything for us' boys. . .